Kris Kristofferson: Dolly Parton, Barbra Streisand, odas pay tribute to Special' singer - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Getty Images30 September 2024Tributes don dey pour in for Kris Kristofferson, di award-winning country singer and actor afta im die at di age of 88.World popular musician Dolly Parton write say "Wat a great loss. Wat a great writer. Wat a great actor. Wat a great friend."She end her post on social media wit di words "I go always love you", wey be one of her most famous songs.Anoda musician wey dey popular well well for di world, Barbra Streisand say "she bin know say im get sometin special" di first time she bin see am perform.Kristofferson and Streisand bin share top billing for di 1976 remake of di feem A Star Is Born.Sean 'Diddy' Combs don get di 11th lawsuit - Who be im accusers?Michael Jackson broda - Tito Jackson die at 70Who be US rapper Fatman Scoop wey die at di age of 53Wia dis foto come from, Getty ImagesFor di feem, dem bin sing togeda on love theme Evergreen, wey bin win Oscar award for best original song, and Kristofferson bin also win di Golden Gl...